How woman with rare double wombs born two babies inside two days

Kelsey Hatcher hold her two newborn babies

Wia dis foto come from, ANDREA MABRY/UNIVERSITY OF ALABAMA AT BIRMINGHAM

Wetin we call dis foto, Kelsey Hatcher wit her daughters Roxi (L) and Rebel (R) – bin learn as teenager say she get two uterus

One woman for US wey get two womb don born two times inside two days – afta one "one in a million" pregnancy and total of 20 hours for labour.

Kelsey Hatcher, 32, deliver one daughter on Tuesday, and di second one Wednesday, for University of Alabama for Birmingham (UAB) Hospital.

Announcing di arrival of her "miracle babies" for social media, Hatcher hail di doctors and nurses say dem dey "incredible".

Dem describe di girls as fraternal twins – wit separate birthdays – dis na rare mata.

Hatcher say di family don go back home now to "enjoy di holidays". Before, she bin dey expect say she go born for Christmas.

One UAB obstetrician confam say di three dey do well, and tell BBC say na dat kain case wey most pipo for her profession go "go through dia whole careers and never see".

Madam Hatcher bin dey 17 years wen tell her say she get double womb or uterus (uterus didelphys) – wey UAB say na rare case or congenital anomaly wey dey affect 0.3% of women.

And di chance of carrying belle wit di two womb - dicavitary pregnancy – dey even smaller, na "one in a million", according to UAB.

Reports of dis kain case dey extremely rare for world.

For 2019, one doctor for Bangladesh tell BBC say one woman bin born twins almost one month afta she deliver premature baby for her oda uterus.

Hatcher bin don get three healthy pregnancies before.

Dis time, she bin believe say na for only one of her uterus she carry belle - until one ultrasound check up wey she go come show say anoda pikin dey di second one.

"I wan faint.. We just no fit believe am," she remember.

She come begin write down her unusual waka wit di pregnancy for Instagram.

One update wey she do during 38 weeks of pregnancy she ask: "What di heck?! HOW we don make am dis far?!"

Mother Kelsey hatcher, her two daughters and husband Caleb

Wia dis foto come from, UNIVERSITY OF ALABAMA AT BIRMINGHAM

Wetin we call dis foto, Kelsey, here wit her newborns and husband Caleb, bin first tink say na for only one womb she bin get belle

UAB describe her pregnancy as routine. Prof Richard Davis, wey co-manage di delivery, point out say each baby bin enjoy "extra space to grow and develop".

Dis na becos each pikin get one womb for imsef, im say - unlike for typical twin pregnancy.

Dem induce Hatcher labour at 39 weeks, and e bin require double di amount of monitoring and charting for di hospital - as well as double di staff.

Dis prove to be "di most abnormal" part of Madam Hatcher case, Dr Shweta Patel from di hospital obstetrics and gynaecology team, tok.

UAB staff bin no get "plenty lot of evidence or data" for hand, Dr Patel tell BBC, and dem bin dey required to apply dia knowledge of normal pregnancies.

Sure enough, di babies bin get "dia own mind", she say - and dem deliver dem wit different methods.

Di first, Roxi, dem born am through di vagina around 19:45 local time on 19 December. Di second, wey dem call Rebel, come by C-section more dan 10 hours later.

Prof Davis say dem fit call di girls fraternal twins – meaning say each baby develop from separate egg, na separate sperm fertilise each egg.

"At di end of di day, na two babies inside one belle at di same time," im tok. "Dem just get different apartments."

Wetin be Uterine Didelphys?

According to sabi pipo Mayo Clinic, uterus didelphys wey dem dey also call double uterus na congenital abnormality wey no dey common.

For inside female fetus, di uterus dey start out as two small tubes. As di fetus develop, di tubes dey normally join to create one bigger, organ — di uterus.

Sometimes, however, di tubes no dey join completely. Instead, each one go come develop into a separate structure.

Di double uterus fit get one opening (cervix) into one vagina, or each of di uterine cavity fit get one cervix each.

In many cases, one small wall of tissue dey run down di length of di vagina, dividing dem into two separate openings.

Women wey get double uterus dey often get successful pregnancies.

But di condition fit increase de risk of miscarriage or premature birth.